(continuation)
if a aks wetin dae mona yu
yu go tell mi?
belle wod tranga for rilis oh! i noh izi
posin kin swella am tae
i ton oda ting
padi noh padi
fren noh fren
yu noh know wetin a kip
wety ah noh tell yu
som wod dae, nah if yu tok am
i dae ton tru tru
man kin tok am saful saful
leh im God sef no yerri
belle wod if i tok or noh tok
kin ton denja wod
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment